Talk

Lyrics

Anything I talk make you talk am again
 Eh eh, talk am again
 Anything I talk make you talk am again
 Eh eh, talk am again
 Brother Muric shout finish, we no see am for court
 Eh eh, we no see am for court
 Election don dey come, they go need your support
 Eh eh, need your support
 Since EFCC burst in, we no see you for club
 Eh eh, we no see you for club
 And you get legit work o, major writing you talk
 Eh eh, na wetin you talk
 Na you talk am o
 No be me talk am o
 Na you talk am o
 No be me talk am o
 Na you talk am o
 No be me talk am o
 Na you talk am o
 No be me talk am o
 Four year tenure, three year holiday
 Eh eh, three year holiday
 Our senator, don dey fight, Kung-fu again
 Eh eh, fight Kung-fu again
 Shey dem never tire, they wan continue the race?
 Eh eh, they wan continue the race
 We buy your story, but you no give us change
 Eh eh, you no give us change
 Na you talk am o
 No be me talk am o
 Na you talk am o
 No be me talk am o
 Na you talk am o
 No be me talk am o
 Na you talk am o
 No be me talk am o
 Anything I talk make you talk am again
 Eh eh, talk am again
 Anything I talk make you talk am again
 Eh eh, talk am again
 Month don end, oga pay salary
 Eh eh, oga pay salary
 In 2019, Nineteen (19) eight (8) alawee
 Eh eh, Nineteen (19) eight (8) alawee
 Instead of make you work, you dey find Alhaji
 Eh eh, she dey find Alhaji
 You come turn your body to cash and carry
 Na you talk am o
 No be me talk am o
 Na you talk am o
 No be me talk am o
 Na you talk am o
 No be me talk am o
 Na you talk am o
 No be me talk am o
 Three private jets, you say you buy am for church
 Eh eh, say you buy am for church
 But your congregation no dey follow fly am of course
 Eh eh, dem no dey fly am of course
 Why your people still dey carry carry eye for someone
 Eh eh, dem dey carry eye for someone
 Shey I no be person
 'Cause no be your tribe I come from?
 Eh eh, cause no be your tribe I come from
 Small man thief for market
 You set fire for em body
 Big man thief money we dey hail am like dummy
 We dey suffer, we dey smile
 We dey fear to talk
 My people no get chop, my people no get work
 These days we no know if authority dey for office
 'Cause the yawa wey we see, no be security wey you promise
 And the cup e don full, we don tire for all the rubbish
 All the punishment
 Na me talk am o!
 

Audio Features

Song Details

Duration
02:31
Key
10
Tempo
69 BPM

Share

More Songs by Falz

Albums by Falz

Similar Songs