Alagbon Close

Lyrics

Now listen
 Now listen
 Now listen
 Never mind, never mind, never mind
 I dey do my part
 I be human being like you like you
 Now listen eh
 Now listen ah
 Never mind, never mind, never mind
 I dey do my part
 I be human being like you like you (eh)
 Now listen
 I be agbepo
 I dey do my part without me your city go smell like sh-
 Never mind I dey do my part
 I be human being like you
 I be civil servant
 I dey do my part
 Without me everything go scatter for town
 Never mind I dey do my part
 I be human being like you
 I be doctor, I be lawyer
 Without me you go die, you go for jail
 Never mind I dey do my part
 I be human being like you
 I dey sing, I dey dance, I dey paint
 Without me you no go happy at all
 Never mind I dey do my part
 I be human being like you
 I dey for court, I dey judge your case
 Without me policeman go lock you for life
 Never mind I dey do my part
 I be human being like you
 Never mind, never mind I dey do my part
 I be human being like you like you
 Now listen
 Now listen
 Now listen
 Alagbon dey roll
 Like one yẹ'yẹ ball
 Wey one yẹ'yẹ wind dey blow
 From one yẹ'yẹ corner
 Now listen ah-ah-ah-ah
 For Alagbon
 Dem go know say you be labourer o
 Dem go lock you till you die
 Magistrate no get eye for back o (na-na-na-na-na-na-na-na-na-na)
 For Alagbon
 Dem go know say you be civil servant o
 Dem go lock you dem no go mind
 Your lawyer go quench for station o (na-na-na-na-na-na-na-na-na-na)
 For Alagbon
 Dem no care for Doctor or Lawyer
 Dem go lock you and charge you for court
 Magistrate go start talk oyinbo for you (na-na-na-na-na-na-na-na-na-na)
 For Alagbon
 You go sing and quench for jail
 You go dance and paint for cell
 Before they charge you before you go
 Ah-ah Yeparipa
 For Alagbon, for Alagbon, for Alagbon na-na-na-na-na
 Dem no get respect for human being
 Dem no know say you get blood like them
 Dem go send dem dog to backbite you
 Dem go send dem dog to backbite you
 Dem go point dem gun for your face
 The gun wey dem take your money to buy
 They don't want my help with dem gun
 The gun wey dem take my money to buy
 Dem go sure take their statement from you
 For Alagbon
 Dem go sure take their statement from you
 For Alagbon
 Dem go lock you for months and months and months
 And they call am investigation
 Dem go lock you for months and months and months
 And they call am investigation
 Dem go lock you for months and months and months and months
 If you no dey for Alagbon
 Make you tell them make dem hear
 If you no dey for Alagbon
 Make you tell them make dem hear
 Uniform na cloth (na tailor dey sew am)
 Tell me now now now
 Uniform na cloth, na tailor dey sew am
 Tell me now now now now now
 Uniform na cloth, na tailor dey sew am
 Na tailor dey sew am like your dress
 Uniform na cloth, na tailor dey sew am
 Na tailor dey sew am like my dress
 Uniform na cloth, na tailor dey sew am
 Nothing special about uniform
 Uniform na cloth, na tailor dey sew am
 Nothing special about uniform
 Uniform na cloth, na tailor dey sew am
 Uniform na cloth, na tailor dey sew am
 Uniform na cloth, na tailor dey sew am
 Uniform na cloth, na tailor dey sew am
 Uniform na cloth, na tailor dey sew am
 Uniform na cloth, na tailor dey sew am
 Uniform na cloth, na tailor dey sew am
 Uniform na cloth, na tailor dey sew am
 Dem go lock you for months and months and months
 Dem they call am investigation
 Dem go lock you for months and months and months and months and months
 

Audio Features

Song Details

Duration
17:03
Tempo
118 BPM

Share

More Songs by Fela Kuti

Albums by Fela Kuti

Similar Songs